agency report am.
"Dis one prove di ability of di judiciary and police forces to fight against old and new mafia groups wey dey try to extend dia criminal reach and expand dia business," Interior Minister Luciana Lamorgese tok for one statement.
Who be di Black Axe?
Dem be one of di most notorious secret societies to ever come out of Nigeria.
Di Black Axe surfaced in di 1970s and dem be originally known as di Neo Black Movement. Diq founders say di aim of di group na to "liberate" di black race.
But for universities, di group no longer dey follow any political ideology. Instead, Black Axe members don chop accuse of plenti killings and sexual attacks.Other Nigerian secret societies, also referred to as confraternities and campus cults, get names like Vikings, Eiye (a word in the local Yoruba language for bird), and di Buccaneers.
Dem get a chain of command wey dey similar to militia groups, use code words and get insignia bearing di favourite weapon of di cult, along wit di colour.
Dem dey promise dia members protection from rival gangs, but na mostly about power and popularity.
Nigeria don ban dis secret societies, and hundreds of members don gbab arrest and serve punishment over di years.
Nevertheless, dem continue to dey operate for di kontri, especially on university campuses, wia dem still dey attract new members.
0 Comments